Sunday, October 13, 2013

The cry of a unizik student to Asuu and FG!!!

The unizik student cried as he expressed how missing school had made him miss a part of hime. He expressed that not been in school made him lack something he tagged as UNIZIK TABLET
I miss TRACAS DRIVERS(Very rude people, if u no wan
pay 4 load(as small as a polybag)come down)
I miss LAMITEL HOTEL FOR TEMP.SITE (wia 5 guys wey
no sabi swim,go dey huzzle 2 teach 1 gal how to swim)
I miss ADMIN SIDE (wia I dey go chop beans n ripped
plantain for afternoon esp. wen e fresh na highest)
I miss MANAGEMNT (wia we dey charge our fones n
laptops.xpecially IFITE pple wey dey carry der
rechargeble lantern cum skool to charge am cos dem
no dey get light)
I miss YAHOO JUNCTION FOR IFITE (wia we go sit down
4 DR shop, chop biscuit, bread & pure water, eat
fries ,and some go com smoke some weed join)
I miss JAM IYKE HOSTEL (wia we dey gym 2 get by force
muscles)
I miss GURLs HOSTEL(wia babes dey form like say na
dem papa get d hostel, home of witches)
I miss JOY HOSTEL SIDE FOR IFITE(whr u buy ur
BB,LAPPY @very cheap rate bold5-2k,Q10-5k LAPPY-5k
esp wen semester wan end)
I miss SKOOL BAK GATE,IFITE GATE(wia wit #100 u go
chop 2fufu + 2meat.wen we dey broke)
I miss MADONNA COUSINE (wia wit #300 we are
satisfied wit 2GRAINs of unsweetened RICE bcos we dey
wit babe)
I miss UBA BANK ( wia we all queue up just to pay
deptartmental fee n oda fees..well e don master us)
I miss PALS FOR TEMP SITE (wia temp siters dey hang
out for evnn tym dey for form boss for babes..dey pop
andre n magic momnt)
I miss UNIZIK ANTI -CULT(wey dey alwz intimidate der
fellow guyz cos som fyn babe dey behind dey watch
am..I reserve ma comments sha)
I miss FAYROUZ (hmm!!!wia all d yahoo bois dey show
theirsef, dey buy beer for crates dey chop friday akpu n
egusi soup, babes wear long skirt @ day time and short
skirt @nyt)
I miss TEEZERs wey dey always dey empty evn wen fayrous wna full die
UNIZIK GIRLS(they sabi take care of boyz, dey go feed
u,cloth u,house u and d boi go still dey cheat on u on
top #na luv sha).I miss HOLY FAMILY babes.wia we
dey go shyke innocnt gurlz wey nvr spoil..lol
I miss skool lik madt:( ASUU pls end d strike. Pls write ur sch tablet and send it to me www.freshdealers@gmail.com
Cc _coperate_streetBoy @freshdealers
Sent from my BlackBerry wireless device from MTN

No comments:

Post a Comment